This was the cause of the banning

 

Emirates flight ban on Nigeria dey come barely 48 hours afta UAE announce plans to resume flights connecting Nigeria to Dubai.


"In line wit goment directives, passenger flights to and from Nigeria (Lagos and Abuja) dey suspended wit effect from 21 June 2021 until further notice."


Na wetin Emirates tok inside statement BBC Pidgin cari eye see.


Canada immigrants wit valid COPR fit travel from June 21 - See di updated travel rule hia

"Customers travelling to and from Lagos and Abuja no go dey accepted for travel.


"Customers wey don travel to or connect through Nigeria inside di last 14 days no dey permitted to board from any oda point to di UAE,"


Na so di airline further add put for di statement dem post for Emirates website.


Dubai Supreme Committee of Crisis and Disaster Management release new travel protocol on 19 June to resume flights from Nigeria.


Di eased travel rules wey suppose start Wednesday 23, June, 2021 also affect passengers arriving from India and South Africa.


"We regret di inconvenience wey e cause, and affected customers gatz contact dia booking agent or Emirates call centre for rebooking.


"Emirates remain committed to Nigeria, and we look forward to resuming passenger services wen conditions allow." Emirates add.

Comments

Popular Posts