Emirates Ban Nigeria Persenger

 

Since 4 February, 2021 Emirates Airlines stop to dey airlift Nigerians to Dubai from Abuja and Lagos airports.


Di ban na sake of di refusal by di Presidential Taskforce on Covid-19 [PTF] to allow di airline conduct rapid test for coronavirus.


Di airline make dis test compulsory for dia passengers, four hours before dem board dia flights.


But di arrangement no go down well wit Nigerian Federal Goverment authorities.


Presidential Task Force on COVID-19 [PTF], according tori wey dey ground, dey plan to provide di infrastructure for Emirates Airlines.


Di plan na to conduct Rapid Antigens Test [RDT] on passengers wey wan fly from Nigeria in readiness for di resumption of flights.


But wit dis latest travel update, Emirates flights from Nigeria fit no dey available for a longer time.


"Emirates flights" travel update: Emirates ban Nigeria passenger flights indefinitely

WIA DIS FOTO COME FROM,EMIRATES FLIGHTS

Wetin dey Dubai Nigeria new travel rule before di ban?


Passengers from Nigeria to Dubai:


1. Passengers must don receive a negative test result for a PCR test wey dem take within 48 hours before departure. UAE citizens no dey affected.


2. Passengers gatz show a negative PCR test certificate with a QR code from labs wey Nigerian goment approve.


3. All passengers must undergo one PCR test wen dem arrive for Dubai airport.


4. Transit passengers gatz comply with entry protocols of dia final destination.

Comments

Popular Posts